DJ PRINCE-J ENTERTAINMENT WORLDWIDE
Nigeria police say dem don rescue di
Assistant Police Commissioner and di Area Commander of Suleja, oga Musa
Rabo, wey kidnappers gbab on Saturday.
Dem kidnap oga Rabo along Barde to Jos road close to Kanock fores wen im bin dey travel.
According to di police, dem rescue di officer on Sunday evening and also arrest two suspects wey dem say get hand for di mata.
- Kidnappers gbab police oga, demand for ransom
- Kidnappers demand palm oil, yam, Schnapps as ransom
Police say na di combined team of police from Kaduna, Niger and
di Zone 7 Command Headquarters Abuja, plus members of di ogbonge Special
Forces of di police to rescue am.
Dem add say di kidnappers bin
no target di oga Rabo as officer but na opportunity dem see to gbab
somebody as im bin dey travel without im uniform or escorts and special
security.
Police bin release statement say dem go work hard to
free oga Rabo afta di incident happun and say di kidnappers bin ask for
ransom.
We appreciate you for reading and downloading on djprincej, but we think it will be better you like our facebook fanpage and also follow us on twitter below.
Title :
Police oga wey kidnappers gbab don regain im freedom
Description : Nigeria police say dem don rescue di Assistant Police Commissioner and di Area Commander of Suleja, oga Musa Rabo, wey kidnappers gbab ...
Rating :
5